United Kingdom, Canada and Australia don formally announce di recognition of Palestinian state. UK Prime Minister Starmer announce say UK dey now formally recognise Palestinian state. “Today, to revive di hope of peace and a two-state solution, I state clearly – as prime minister of dis great kontri – say di United Kingdom formally recognise di state of Palestine,” e tok for one video statement. Dem cite images wey show starvation and violence for Gaza, wey Sir Keir previously describe as “intolerable”. Earlier dis week, one United Nations commission of inquiry bin conclude say Israel commit genocide against Palestinians for Gaza, wey Israel denounce as “distorted and false”.