Authorities for di National Assembly bin seal her office on 6 March 2025 afta di Senate suspend her for six months for misconduct. Di supporters march from di FCT High Court to di National Assembly wia she finally gain access into di law making premises. Una remember say on 22 July, 2025 Senator Natasha Akpoti-Uduaghan bin try to enta di National Assembly premises but security pipo bin no allow her. Dem bin adjourn di mata till Tuesday from di last sitting wey bin happun on 19 June, 2025. She add say di worst tin wey di former govnor of Akwa-Ibom State fit do na to suspend her.