None
EN
Harsh weather conditions for South Africa force govment to issue warning, close schools
['Bbc News Pidgin']
Information Nigeria Pidgin
Already many roads don dey closed and dem don riase weather alerts sake of disruptions for many provinces across South Africa.
Oda provinces wia pipo dey also experience heavy rains and bad weather conditions include Mpumalanga and Western Cape, wia some routes dey affected by icy conditions and strong winds.
Di Weather Service don raise di alert level to ‘Orange Level 6’ as snowfall affect some of di major routes and mountain passes for Eastern Cape and Free State provinces.
Di advice na for drivers to approach di roads “wit extreme caution”.
Tokelo Chiloane, wey be senior forcaster for di South African Weather Service explain say ‘cut-off low’ na weather system wey dey develop at around 500 millibar level for di upper atmosphere.