BBC investigate wetin happun, and find di Emir entourage for di entrance of one conference room for di university Faculty of Law. Di source tell BBC say di examination go start on 10 August – and up until dat time, di Emir never write any examination. Dem say dem record di video for one event wey di university Law students organise on Saturday. Some of di students wey dey study wit di Emir again confirm say Emir Sanusi never fail any examination. “We attend one event wey di university Law students organise on Saturday, and na one student record di video.