None
EN
‘She die di day we end our externship’ – Wetin we know about death of 23-year-old law school student wey die for Lagos campus
['Bbc News Pidgin']
Information Nigeria Pidgin
Tori wey dey trend be say di female law students bin jump from di top of a corridor for di Law School campus wey dey Lagos.
One veri close friend to di deceased say di incident shock her as she hear of di death of her friend becos she no first believe.
“Preliminary information show say, about 4:00am on Friday, 7 August 2026, di student fall from di rooftop of di hostel wey dey di Campus, and sadly, e no survive di incident,” di statement tok.
“Di management extend dia deepest condolences and sympathy to di family, colleagues and all di pipo wey di mata affect.
According to di school management, di family of di deceased go like to grieve privately and make di media and public allow dem mourn her death.