You see, di problem of insecurity for Mali, Burkina Faso and Niger dey worsen our difficulties”. Di security problems for Mali, Burkina Faso, Niger Republic dey add more fuel to Nigeria security challenges. E observe say Niger don dey wage wars against Boko Haram insurgents long bifor jihadism take off for Burkina Faso and Mali. Di diplomat also acknowledge wetin Burkina Faso describe as di “considerable efforts” wey di three AES countries dey do to combat terrorism. While Nigeria remain committed to Ecowas, Burkina Faso, Mali and Niger don distance demsefs from di bloc and form dia own alliance.