E tok say no military pull-out go happun until Hamas don “genuinely” disarm. Trump for last month announce “one ogbonge step toward lasting peace and security” afta Hamas tok say dem don accept one disarmament plan for Gaza. But Netanyahu say Hamas gatz disarm bifor Israel withdraw dia forces from Gaza, and e add say e fit be some “fake disarmament”. Just months bifor Israeli elections, di Israeli prime minister most likely no go like make compromises. Dis signal anoda blow for Trump Gaza peace plan wey dem announce for September last year.