Di Indomitable Lionesses of Cameroon go face di Super Falcons of Nigeria for di quarter-finals of di 2026 Women Africa Cup of Nations. Nigeria Super Falcons na di defendng champions for Wafcon afta dem win di title for a record 10th time for di 2024 edition wey dem play for 2025. Cameroon and Nigeria dey meet for di Wafcon finals for di 14th time, e make am di most-played fixture for di history of di competition. For di 13 times wey dem meet, Nigeria win nine for open play and anoda two on penalties. Nigeria dey appear for dia third Wafcon quarter-final and dem win dia previous last-eight encounters, against Cameroon in 2022 and Zambia for di previous edition.